Dem call am law
We take am raw
Dem say dem go school
And dem no go stop to loot..
How we people
wan tek akomplish mission
When we
nation no get vision?
Dem say na politics,
Why dem com dey play us tricks?
Dem say na govment fo di pipul
Oya make dem stop to fizzle
Dem go give us sack letter
Say make we come back later
How we wan tek be nation
If we dey lak notion?
Me ah neva si dis kain politics
With empty promises
How we wan know beta tin?
If dem no stop to giv us bita tin?
But make una no worry,
Very soon we go stop to hia sorry
Wen I become president
All we go dey si na excellence
Written by: Williams Enechojo UniqueGloria
Edited by: Kukogho Iruesiri Samson
*Na big wok yu du o Puet Gloria, a trowe salot*
BETA TOMORO (naija languej)
Dem kol am loo
Wi tek am roo
Dem se dem go skul
And dem no go stop to lut
Hau wi pipu
wan tek akonplish mishon
Wen wi
neshon no get vishon?
Dem se na politiks
Wai dem de ple os triks?
Dem se na govment fo di pipu
Oya mek dem stop to fizul
Dem go giv os sak leta
Se mek wi kom bak léta
Hau wi wan tek bi neshon
If wi de lak noshon?
Mi a neva si dis kain politiks
wit dem emti promis
Hau wi wan nou beta tin
If dem no stop to giv bita tin?
Bot mek una no wori
Veri sun wi go stop to hia sori
Wen a bikom president
Ol wi go de si na eselens
yu do trai
I love this poem. Sounds like my kind of poem; change directed.
I appreciate the writer and editor; Samson’s in pidgin English.
However, please find a Niaja languej translation of same poem for further appreciation and comments.
BETA TUMORO
Dem kol am ”law”
Wi tek am ”raw”
Dem se dem go skul
Dem no go stop to ”loot”…
Hau wi pipul wan tek finish mata
Wen wi neshon no sabi mata?
Dem se na politiks…
Dem de ple os ”trick”…
Dem se na govment fo di pipul,
Bot dem no sabi di pipul.
Dem de giv os sak-leta
Se mek wi kom bak afta
Hau wi wan tek bi neshon
If wi no gada eni akshon?
A neva si dis kain politiks bifo
Emti-kokon neva chenj from bifo.
Hau wi wan nou beta tin
Wen dem no de giv os beta tins?
Trowe ol una wori,
Una nem no de fo eni sori.
Wen a bikom una President,
Ol wi go de si, na selense.
Hu rait am na: Williams Enechojo UniqueGloria
Hu chenj am to Naija: Eriata Oribhabor
Foto: Words Rhymes & Rhythm
Wow, this is super Sir.